By Chuks Iloegbunam

The mantra was of Master and Strategy,
Strident, insistent and monotonous.

But when the Come came to Become,
Osun tell the world say dem no dey carry last.

Dem talk say dem prefer sombodi wey dey dance like no man business
Than person wey him feet no fit carry him bodi at all at all.

Dem talk say Osogbo no get space for person wey Prince Charles dey lead by the hand
So, therefore, If Charlie Boy of Buckingham no get chance,

Make feeble limbs crawl go back, cap in hand, to Ankara once more again,
Yes, and kia-kia, to ask boya Presido Erdogan go play walking stick once more again.

Yes, Osun see the Master finish; dem see am well, well
But the man no give dem something to masticate, only long turenchi.

Osun come vex because big grammar no be stomach infrastructure;
Oyibo repete no fit buy ordinary alabukun.

Osun take koro-koro eye see Strategist; but na only dem pocket the man strangulate
Na him make dem no fit buy fuel for motor, no fit buy fuel for okada,
No fit buy fuel for ordinary I-Pass-My-Neighbour!

Therefore, dem come remember the Master promise of the day before yesterday:
“If I no give una NEPA, make una carry okpokpo drive me comot!

Yes, make una chase me into Hades when I come say vote for me once more again.”

Na true say tomorrow dey far, but na only for person when strategic hunger kpai today
Na him make the day of reckoning come come for Osun State.

Na him Osun pipu come remember say khaki no be leather
Dem no forget, fine pipu of Osun, say kinkana no de sour.

Abeg, if you see any son or daughter of Osun State, abi na State of Osun?
Make una salute am well, well: dem head dey kampe on top of shoulder!

Maybe Osun pickin no see money buy whiskey; him no kuku care for Abuja liquor
Him shout say, even if na only ogogoro we see drink, our head dey clear like morning light.

Dem come begin ask plenty plenty questions:
Wetin concern centre rank with open order?

Wetin concern agbero with overload?
Wetin virgin forget inside maternity ward?

Why turtle dey boast say him name na eagle?
Wetin concern us with person wey we no know him name?

Person wey we no know from where him from come from!
Person wey we no see even the photocopy of him safiticate!

We no kuku know boya na for St. John abi na Ahmadiya Primary him go school.
Osun pipu come begin dey clap and sing; dem come start singing and clapping.

As dem dey clap and chant, na so dem dey gyrate and vote
Dem sing say, whether dem carry pákò bludgeon or truncheon come
Abi na machete or teargas or rifle or 106…

We no go vote for lootocracy
No more again.
We no go vote for plutocracy.

No more again.
We no go vote for gerontocracy
No more again.

Osun pipu get sense, no be small
Dem come join courage put for their high sense,

Dem come swear say propaganda no dey kill hunger
Propaganda no dey kpai insecurity, e no dey kaput joblessness.

Propaganda dey carry teacher and pupil from classroom to kidnappers’ den
Propaganda dey create IDP camps for east, west, north and south.

E dey carry money give terrorists take buy more guns and laugh suffering pipu for video.
Brethren and sistren, look out into the streets and byways and highways.

View the trunk-ways, the alleyways and the railways.
Behold the spectacle of the massive throngs of joyous processions.

At the lead, the corpulent one, his cap pointed to heaven in deference to the Owner of all.
He is dancing, prancing, leaping with agility;

In one hand, he holds that torch of a powerful beam, in the other a loudhailer.
His message is to Abuja and the thirty plus six states of the entity.

His message, loud and clear, is to Nigerian citizens
And to the denizens of this country’s various villages, towns and cities

Better give an ear to his food for thought:
We have seen the light.

It is ablaze on the horizon, homing into a fresh beginning.
We have torn the shackles that stuck us in mire.

With pincers we pulled the nails that pinned us to sheets of sorrow, tears, and blood
It is the dawn of a new era.

Every but everyone, beloved brothers and sisters, must join the redeeming train,
As with flagellation, we chase away longstanding wrack and ruin
With the barbed bulala whips of our PVCs.

Don't Miss